Back
Youth Wey Dey Vex Don Kill 3 Pesins Con Even Porsu Ire Ekiti King Commot Ova Ogun Festival
Aug 10, 2020
Youth wey dey vex on Monday bin attack di palace of Onire of Ire Ekiti inside Oye Local Government Area of Ekiti State, Oba Bobade Adeleke, afta di monarch bin invite security operatives to prevent dem from holding Ogun festival due to COVID-19.
Saharareporters bin learn say di traditional ruler and him council bin earlier pass one resolution say di 2020 Ogun festival inside di town no go dey celebrated elaborately becos of COVID-19 and dem gatz follow wetin him talk.
As we furda gada say dis resolution no go down with him subjects especially di youth, wey subsequently attack di palace and porsu di monarch commot
One source bin tell Saharareporters say about three pipu bin dey killed during di fracas while several odas dey wounded.
Di pipu born di vehicles wey belong to di traditional ruler during di incident.
One group of angry women from different communities inside Southern Kaduna on Thursday, July 23, bin stage one protest — nekked — ova di killings wey dey various communities.
Di women from Atyap, Mabushi, Samaru, Tagama, Unjwan Juju and oda neighbouring villages dey protest afta di incessant violence and killings inside Southern Kaduna.
Hundreds of pipu don dey killed inside various local goments of Southern Kaduna inside di past couple of years.
Di killings don kontinu despite di deployment of various military teams to di area.
46Shares
4Comments
1Favorites
22Likes
Say something to impress...
Loading...
Comments
Hot

No content at this moment.

Relevant people
Beta Talk
249471 Followers
News report and Lifestyle in Pidgin
Related